Sunday, December 4, 2016

Hau HIV/AIDS de waka fo IDP kamp dem

If yu de among di pipul we de go du rons fo IDP kamp onto di levul of man and wuman mata, i go gud mek yu shain yo eye o.

Akodin to Malam Barkindo Saidu, we bi Executive Secretary, Borno Agency fo Control of HIV/AIDS, BOSACA,  512 niu pipul don get HIV fo di Internally Displaced Persons, IDP kamp dem fo di stet.

Saidu bin tel niuz pipul on Sunday fo Maiduguri se na as dem de help displaced pipul chek dia HIV status na im dem kom diskova se 512 of dem kari di virus and i neva tay we dem get am. Im kom tok agen say insaid di 512 pipul we get HIV, 2 na smol smol pikin.

Saidu olso tok se di pipul we dem de tochlait wel wel na di pipul we Boko Haram bin kapsho bifo.

Im esplen say fo di hol of Borno Stet, na 108,000 pipul de strogul wit HIV/AIDS bot na onli fiu pipul de risiv tritment bikos ol di pipul we bin de help dem don klos dia ofis ron.

Saidu kom beg fedral govament to help Borno fait HIV as Boko Haram don poshu di pipul we bin de du di wok komot.

NAN

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories