Sins Donald Trump win prezidenshal elekshon fo United States of America, pipul don de ask wen Prof Wole Soyinka go tear im green card.
Rimemba se Soyinka bin tok bifo di elekshon say if Trump win, im go tear im green card.
Nau, as Trump don win, pipul de ask di Nobel Prize for Literature wina say "oga na wen yu go du wetin yu tok na?"
As tins de nau, di man don de riplai di pipul we de kritisaiz am.
"Una no go wait fo mi fest? Say a no tear mai green card di moment we dem anauns se Trump don win no min se a no go du wetin a tok.
"Ivun Obama we stil de fo pawa, dem giv am enof taim bifo im go hand ova. Ivun Trump we win elekshon go stil wait som taim bifo dem go swear fo am to bikom prezident.
"Na mi we una no go giv taim? Mek una wait mek USA bikom Trumpland fest. Na dat taim una go si se a go pak ol mai kaya komot fo America."
Soyinka kom tok se di pipul we de tel am to tear im green card shap shap na pipul we no de ondastand tins wel bifo dem go tok.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.