Sunday, October 30, 2016

Mek una no vex, Bello beg Fulani fo Kogi

Afta som pipul go kil di chiaman of "cattle breeders" fo Kogi stet, Wuro Miyetti-Allah Association, Alhaji Ibrahim Abubakar, Govano Yahaya Bello don beg Fulani pipul se mek dem no vex.

Im Chief Press Secretary we bi Petra Akinti Onyegbule bin tel niuz pipul on Saturday se di govano don join bodi wit sekuriti pipul to luk fo di pipul we kil di man.

"I pen mi no bi smol wen a hie hau Alhaji Ibrahim Abubakar bin dai tode. A kari di nem of di beta pipul of Kogi stet de beg Wuro Miyetti-Allah Association se mek dem kul dia maind fo dis bad tin we hapun. A go join bodi wit ol di sekuriti ejensi dem to mek shuo se wi kach di pipul we du am.

“A de pre mek Almighty Allah grant Alhaji Ibrahim Abubakar Al-Jannah Firdaus.” Na wetin Govano Yahaya Bello tok bi dat.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories