Durin di taim we im go Argentina fo dia mach wit Uruguay, Lionel Messi bin tok wit TV steshon Telefe and komedian Miguel Angel Rodriguez abaut wetin mek am ritaya from Argentina and wai im chenj im maind.
"Na wetin a de feel fo dat moment bi dat. I kom bi laik se evritin kom krash on top of mai hed. Wi bin tink se na awa oposhuniti to folo Argentina win taitul bikos of di kain pleyas we wi get, hau di tim de ple and hau wi waka rich fainal. Wi bin nid dat taitul pas evribodi. Ol of os bin get dat dream to win somtin wit awa nashonal tim. I rimen smol mek wi get am, bot di tin kom end wit big disapointment."
Messi tok se dat penariti difit we dem sofa fo Chile hand fo Copa America 2016 rili kil im spirit, bot as taim kom de pas, we niu manija Edgardo Bauza kom tek ova, im kom si se na mata of taim bifo im go win somtin wit Argentina. Na wetin mek am kansul im ritayament bi dat.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.