Wednesday, August 31, 2016

Profet rape smol boi fo choch afta nait vijil

Polis fo Anambra Stet don arest Ekene Aboji, we bi 35 yiez old a profet wit Jesus Miracle Ministry, Ifite-Awka, bikos dem tok say im rape 13-yiez-old boi fo dia choch afta nait vijil.

Anambra Stet Polis Poblik Rileshon Ofisa, ASP Nkeiru Nwode tok fo Awka yestade say na fo August 19 di profet du dis bad tin to di smol boi insaid di choch kompaund.

Nwode tel niuz pipul say medikal ripot sho se di profet bin wund di boi fo im nek and anus.

“Dis na kes of homosexual and onnashoral ofens; na situashon wia pesin folo bakyad go enta smol pikin.

“Di smol boi bin go nait vijil and di profet kom tel am to slip fo choch as taim don tu late fo am to go haus, onli fo di profet to kom enta im anus bai fos.

“Wen polis get di infomeshon, wi kom go di choch to arest di profet bot di man ron o.”

Afta polis arest im moda in law na im di man kom sho fo polis steshon.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories