Wednesday, August 17, 2016

Ogogoro don kil 4 pipul fo Ogun Stet

4 pipul don dai fo Abeokuta, kapital of Ogun Stet afta dem drink kaikai, aka ogogoro.

Dem say 3 of di pipul bin dai fo di ogogoro joint, but won pesin bin kari waka afta im don komot fo di ples.

Police de sospekt se di ogogoro get tu mosh ethanol insaid. Dem don arest di ogogoro sela we bi Salako Taloju.

Taloju na gateman we de ogogoro fo kiosk oposit di haus of won big politishan fo Ibara – Abeokuta.

Polis tok say di pipul we dai na
Baba Imeko, Baba Onwenue and Easy.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories