Lionel Messi fit bi di pesin we sabi tap futbol pas fo di wold bot fo bed, im no sabi enitin.
Argentina model, Xoana Gonzalez bin tok somtaim fo 2011 say shi bin slip wit Messi afta won pati laik dat.
Bot na nau di model kom tok wetin shi si fo Messi had dat taim. Shi tel di TV steshon fo Peru se Messi no pafom fo bed at ol.
"Dis tin bin hapun meni yiez ego. A nou se im bin de veri yong dat taim, bot im no bi smol boi laik dat.
"A tok say im no get liva bikos im no ivun tok to mi bai imsef. Na sekuriti pipul im send to aprosh mi.
"As a kom si se na Messi de kol mi, na so mai bodi kom friz. Dat nait, na onli muzik wi tok abaut. A no fit rimemba weda im bin tok se im get girlfrend ou not. Afta som taim, wi kom enta im rum fo Puerto Madero.
"Wen sombodi de ple futbol ol ova di fild, yu go espekt se im go fit mek pesin hapi fo bed. A de espekt se im go du mou dan wetin im de ple fo fild bot i kom bi laik se a bi ded bodi fo bed."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.