Laif na buk.
Dem no de rid am finish.
Wen yu tink se
Di buk don de mek sens,
Na dat taim yu go si
Anoda shapta we yu no nou.
Dis buk we dem kol laif na wa.
I get plenti kona-kona fo "road".
Ivun potopoto sef de.
If yu no put ai fo grand,
Yu fit put leg fo potopoto
Ou ivun enta kona-kona we yu no go fit komot.
If yu de rid buk,
Shain yo aiz mek yu nou wetin di buk de tok.
If yu de waka fo laif,
Opun yo aiz mek yu si wetin de.
I go land, I go land,
Na im botaflai de tek enta bush.
Steve Igbokwe ©2015
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.