Friday, August 19, 2016

Man we "steal" N15,000 tyre don get N100,000 bail

Won Chief Magistrate Court fo Badagry, Lagos Stet don hama Bimbo Iseyin wen dem akiuz se im go tif 2 moto tyre wit N100,000 bail kondishon.

Dem say dis 28 yiez old man we no get adres jos waka enta pesin shop kari 2 tyre de go im way.

On August 11, 2016 fo Mrs Akpan Udom shop we de Joseph Dosu Way fo Badagry na im dem tok se Iseyin komit di ofens.

Akodin to Inspector Innocent Ukoh we bi prosekuto, " di akiuzd jos enta di shop kari 2 tyre ron, bot pipul kom poshu am kach am."

On September 29 na im di mata go kontiniu fo court.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories