Saturday, August 27, 2016

Flavour, Wizkid, Tiwa Savage top AFRIMA 2016 nomineshon list

Di pipul we de arenj di All Africa Music Awards, AFRIMA, last wik bin riliz di list fo dis yie awod as dem sho ol di atist we dem nominet fo di Rijonal Katigori dem.

Fo West Africa, Naija atist dem sho dia levul wit plenti nomineshon, as Ghana get onli 2, wit Cote D'ivoire and Senegal onli 1 ich.

Insaid di list na atist laik Tiwa Savage, Flavour Nabania , Afro Soul Diva, Aramide we dem nominet fo im niu singul, “Funmilowo," we fisho Sir Dauda, Seyi Shay, Temi Doll Face and Yemi Alade.

Oda Naija atist dem we de di list na Brymo, Tekno, Wizkid and Niniola.

Oda kontri we de di list na Ghana wit Sarkodie and Okyeame Kwame; Senegal wit Adiouza and Cote D'ivoire wit Josey.


0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories