Saturday, August 27, 2016

Adeboye dash wuman we born "quadruplets" 2-bedrum flat

Won pawaful testimoni we pipul hie fo di 1-wik nashonal konvenshon of di Redeemed Christian Church of God, RCCG, we finish on August 7, 2016 na di testimoni of Mrs. Nkechi Uche we born 4 pikin at di sem taim.

Mrs. Nkechi Uche bin born ha "quadruplets" of 3 bois and 1 girl tru Caeserian sekshon fo Redeemer’s Health Centre, insaid Redemption Camp.

Naija Languej hie se di waif of Daddy G O (General Overseer) of RCCG, Pastor Mrs Foluke Adeboye don de help di Uche famili we don get sevun shidren nau.

On top of ol di tins we im don du fo di famili, Mrs Adeboye dash dem 2-bedrum flat fo di estet insaid Redemption Camp, ivun as di choch de trai siriosli to faind beta wok fo Mr Uche.

Won pesin fo RCCG tok se di Adeboye famili biliv se "shidren na blesin from God and enibodi we pikin ful im haus, God no go let shem kach am."

Si wetin Pastor Enoch Adeboye imsef tok abaut di shidren.

"Fo di fest taim in di history of awa convenshon and awa mataniti senta,  wuman born 4 pikin at di sem taim."

Si di pikin dem fo piksho.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories