Sunday, August 28, 2016

FG don distroi 15 kontena of ice fish

Di Fedral Govament on Saturday distroi 15 kontena of forin ice fish we bi propati of Food Solution Nigeria Ltd.

Di Deputy Director of Fisheries, Mrs. Olabisi Adepegba tok say na rotin fish de insaid di kontena.

Adepegba tok say na Mediterranean Shipping Company go pe di moni we dem spend to distroi di rotin fish bikos na dem kari am enta Naija.

From Sifax Terminal na im dem kari di fish to Lagos State Waste Management Authority dumpsite, fo Epe, wia dem distroi am , kom giv Certificate of Destruction to di shipping kompeni.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories