Di govament of Burkina Faso don ban di Miss Bum-Bum biuti kontest we dem de du fo fat wumen fo di kontri evri yie.
Dem de du di kompetishon to selekt di wuman wit di bigest bakyad fo di hol kontri. Bot as dem de du advat fo di 3rd edishon we don niali rich na im govament kom ban di sho.
Minister, Laure Zongo tok say “awa oun na to du evritin to avoid damej to wumen imej."
Shi olso tok say govament ban di kontest bikos plenti pipul de komplen abaut am.
Bot di men we de arenj di kompetishon tok se dem de du am onli to promot Afrikan wumen.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.