Saturday, July 2, 2016

Yu fit travul from Abuja to Kaduna bai train fo free nau

Fedral govament wn bai mou koch fo di Abuja-Kaduna relwe savis so dat di train go kari mou pasinja.

Na so Minista of Transpoteshon, Mr Rotimi Amaechi tel niuz pipul fo Abuja on Friday.

Im tok say di four koch we de on graund fit kari onli 380 pasinja, bot di pasinja we de kom to enta tren tu moch.

“Wi don enta rod. Go dia, yu go si pipul de enta train to Kaduna, bot na Prezident Buhari go tok wen im go lonch di savis ofishiali.

“Fo nau, wi no de kolekt moni bikos wi bin tok say na afta prezident don komishon am pipul go stat to de pe moni.

“From wetin wi si tode, di nomba of pasinja we de enta di train don pas di beta koch we wi get.

‘Wi get laik four koch we fit kari 380 pipul and wi get mou dan 380 pesin we wn enta train

“Wi jos disaid say wetin wi nid to du na to get mou koch and mou lokomotiv dem." Na wetin Amaechi tok bi dat.

Di News Agency of Nigeria, NAN de ripot se na fo June dem bigin  test-run di Abuja-Kaduna standad gej relwe.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories