Sunday, July 3, 2016

Wizkid don stat "toilet selfie" revolushon (si piksho)

I neva tey we Wizkid bin shia som piksho wia im sidon fo toilet. A no nou weda im jos sidon dia ou im rili de du toilet biznes.

Som fans tok se Wizkid de sho im swaga fo doz piksho dem, bot oda fans kom de hala se di piksho no mek sens.

Bot wetin de hapun nau bi se plenti ajekpako girls jos de snap diasef fo toilet de post di piksho.
Dem de kol am "toilet selfie" revolushon.

Si som of di piksho we Femi Famutimi bin shia fo Herald.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories