Plenti Argentina fans enta rain on Saturday de hala se dem wn mek Lionel Messi kom bak to di nashonal tim.
Messi bin tok se im no go ple fo Argentina agen afta dia los to Chile fo di 2016 Copa America fainal.
Messi na 5 taim World Pleya of di Yie. Im don ple fo 3 Copa America fainal, in 2007, 2015, and 2016, im olso ple fo 2014 World Cup fainal.
Di tin we de brek Messi heart bi se im don luz fo ol di fainal we im don ple. Fo di Copa America fainal we dem ple last mont agenst Chile, Messi no fit sko im oun penariti.
Afta dem luz di Cup to Chile, na wetin Messi tok bi dis;
"Na di end bi dis. I don du mi. A no wn ple fo Argentina agen."
Bot Argentina pipul and ivun dia prezident we bi Mauricio Macri and Diego Maradona gada on Saturday fo Obelisco (di ples wia dem de selebret dia sports viktri) to beg Messi to chenj im maind.
Hie wetin won fan we im nem na Santiago Bordero tok.
"Dem say pesin laik Messi de kom evri 500 milion yiez and wi de enjoi nau. So wi sopoz to tank God se wi de alaif fo dis taim we Messi de ple futbol."
Anoda fan we kol imsef Juan Alberto Salas tok laik dis.
"Im get to kom bak o. Neva maind se a de emoshonal, bot na wetin a fil bi dat. Fo mi, i no get enibodi we bi laik am. In shot, na god im bi fo futbol.
Reuters
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.