Wednesday, July 6, 2016

Kontena krosh 7 pipul fo Lagos Ramadan trajedi (si piksho)

Araund 7 pipul dai on Wednesday wail 12 odas get difrent taip of injuri fo Lagos - Badagry Expressway wen won trela trowe im 40-fut kontena on top won smol moto and som okada pipul we de dia.

Naija Languej hie se di trela draiva bin luz kontrol fo Alakija bostop as im brek no kom kach.

As im de strogul to kontrol di moto, na so di kontena fol kom land on top of mini bos we kari pasinja and som okada pipul we de hozul fo dia deli bred.

Dem se 3 of di 7 pipul we dai na okada pipul.

LASTMA, LASEMA and police no west taim at ol bifo dem kari ol dis pipul to hospital.

Lagos State Police Public Relations Officer, SP Dolapo Badmos, konfam se na 5 pipul dai fo di aksident.

“Awa men fo FESTAC Police Division bin go dia to help di pipul. As of 4pm, na 5 ded bodi de. Nobodi sabi hu dis ded pipul bi.”

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories