Som Naija sayentists don de hala mek Prezident Buhari du somtin shap shap to ridiuz di damej we di earthquake we wn hapun fo som erias fo Naija go kos.
Dis pipul tok say dia risach sho se earthquake fit hapun fo 6 stets insaid Naija witin di nest 4 yiez.
Dr. Adepelumi Adekunle Abraham of di Department of Geology, Obafemi Awolowo University (OAU), Ile-Ife, na im sobmit di ripot we dem taitul “Preliminary Assessment of Earth Tremor Occurrence in Shaki Area, Shaki West Local Government, Oyo State”.
Di ripot sho se di kain earthquake we go hapun dia in di nest 4 yiez go damej somtin wel wel.
Ivun di National President of the Nigerian Association of Water-Well Drilling Rig Owners and Practitioners, AWDROP, Michael Ale don advais Prezident Muhammadu Buhari to du somtin so dat dis earthquake we wn hapun no go tu kos damej.
Di ples we dem tok say dis earthquake go hapun na Lagos, Bayelsa, Cross River and Oyo Stet plos Warri fo Delta Stet and Portharcourt fo Rivers Stet.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.