3 of doz pipul wey join bodi go kil dat Igbo wuman wey dey sel plastik fo Kano don enta polis hand o.
On Thursday na im som Hausa pipul join bodi go kil Madam Bridget bikos dem hie se shi tok som kain yeye tok abaut dia relijon wey bi Islam.
DSP Magaji Musa Majia Kano wey bi tok tok pesin fo polis fo Kano tok se 3 pipul dey dia hand wey don dey eksplen wetin dem sabi abaut di kil wey dem kil Madam Bridget
Kano kom tok se Police de du evritin to tochlait di mata we well.
Si fo piksho as dem join bodi kil Madam Bridget.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.