Wednesday, June 15, 2016

Polis arenj man we wn kil im girlfrend fo court

Wan Uchenna Okeke we bin wn kil im girlfrend fo Lagos, dem don arenj am fo court o.

Dis 26 yiez old treda we de liv fo Oluwalimu Street, Ikeja, Lagos, dem de prosekut fo di ofens we dem kol "breach of peace and assault."

On Tuesday, na im dem arenj Okeke bifo Ikeja Magistrate Court.

The Prosecuto we bi Inspecto George Nwosu, tel di court se di akiuz bin komit di ofens  on June 11 fo Ikeja, Lagos.

Nwosu tok fo court se on top of pesin we im niali kil, di akiuz stil fait di polisman we go hol am se mek im no kil pesin.

``The accused bit op di polisman kom brek im hed join."

Nwosu say di polisman de wia im de du im ofishal duti kom si di akiuz de asolt wan wuman, de drag di wuman fo graund.

``The pols corporal bin si di akiuz de bit im girlfrend de drag am fo graund. Im kom rosh go dia to stop di akiuz mek im no kil pesin.

``As im wan stop di akiuz from di bitin we im de bit im lova, na so di akiuz transfa ol im agreshon to di polisman bodi.

``I bit am, kom kari ston brek di polisman hed sotey blod kom de rosh. "

Di prosekuto kom tok se ol dis ofens dem we Okeke bin komit, dem kontraven sekshon 166 and 171 of di Criminal Law of Lagos State, 2011, and na 3 yiez insaid prizin dem sopoz to giv am if di court faind am giulti.

As Okeke dinai se im no komit di ofens, na so di judge kom grant am bel wit N100,000 plos 2 shoti dem we get di sem amaunt of moni.

Di Magistrate, Mr A.A Adesanya, ajon di mata til July 6 wen kes go kontiniu.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories