Wednesday, June 15, 2016

Oyel tif tif: 2 pipul don go prizin fo 6 yiez

Insaid Federal High Court, Calabar na im Justice E A Obile on Tuesday sentens tu pipul we tif oyel to 6 yiez insaid prizin. And im no giv dem eni opshon of fain.

EFCC Head of Media and Publicity, Mr Wilson Uwujaren na im tok dis wan insaid di stetment we im riliz to niuz tori pipul fo Abuja.

Dis tu pipul we bi Paul Etim and Edet Okon on Nov 27,2011 di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC bin arest dem kom arenj dem fo court leta.

Dem trai dem on tu-kaunt chaj of join bodi to komit ofens and selin petrol witaut laisens.

On January 24, 2012 na im dem arenj dem fo di 1st taim and dem kom tel di court se dem no de giulti at ol.

Justice Obile tok se dia prizin sentens go stat from di 1st taim we dem apia fo court.

Di judge stil giv anoda orda se mek Naija Navy destroi dat canoe we di konvikt dem kari go tif oyel.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories