Wan Army kaptin we don ritaya we dem kol im nem Friday William don hang imsef on top of mango tree fo Calabar.
Nebos and famili memba dem fo 34 Edim Otop St., Calabar jos wek op in di monin kom si Friday bodi de dangul on top mango.
Nobodi nou wai Friday kil imsef and im no ivun komplen of enitin. And no bi se na bikos of moni Friday tek im oun laif o.
Nebos tok se dis fada of 8 get cars plos di hevi moni we Army bin pe am fo ritayament. Ivun sef, Kaptin Friday don biuld beta haus fo vilej.
Bot dem say Friday bin send wan kain text mesej to im son fo Port Harcourt se as im de dai so, mek di boi de strong, and luk afta im yonga wans dem.
Bifo di boi si di mesej, Friday don hang imsef o.
Eniwe, as di tori de laik dis, dem don kari Friday dedibodi go im vilej fo Mkpat Enin, Akwa Ibom Stet.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.