Tuesday, June 14, 2016

No fud fo Naija, Sultan beg Customs boss

Sultan of Sokoto we bi Alhaji Sa'ad Abubakar III, don beg  Nigeria Customs Service mek dem alau pipul to de folo land boda de impot rice.

Na wen  Comptroller-General of Customs , Col. Hameed Ali (retd), visit am fo palace fo Sokoto on Monday na im Sultan tok dis wan.

Sultan tel Ali se pipul de sofa, de krai se kontri had and fud no dey.

"No fud fo di kontri. So, una get to opun di boda mek rice enta."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories