Friday, June 3, 2016

Neymar na di 1st pleya to join bodi wit Jordan Brand

Nike don tok am se FC Barcelona pleya wey bi Neymar na im bi di 1st futbola wey go join bodi wit dia Jordan Brand o.
Di Brazil pleya go dey wia im oun boot wey bi se na im tel Nike hau dem dizain am fo am.

Dem rait nomba 23 fo di boot wit red and blak tins, kom kari dat  Jordan logo wey bi "Jumpman" put on top.

At di sem taim, Nike go bigin sel som maket wey kari Neymar/Jordan fo bodi.

Dis Neymar niu shoe get teeth wey rizembul shark oun, kom kari Neymar im nem fo tong.

Nike tok se na fo Brazil Olympics Neymar go stat to de wia di niu shoe wey dem dey kol Neymar Hypervenom.

Di piksho wey yu si hie na from
Manuel Queimadelos Alonso/Getty Images

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories