Saturday, June 4, 2016

Messi and im papa fit go prizin fo 22 months

Di man wey sabi ple futbol pas, Lionel Messi and im papa wey bi Jorge Messi don dey tel court fo Spain wetin dem sabi abaut som kain jibiti wey govament tok se dem ple insaid di tax wey im sopoz pe.

Prosekuto fo di mata dey akiuz papa and pikin se dem haid di moni wey Messi bin mek fo som of im bank akaunt wey dey awusaid Spain.

Dat wan min se Messi and im papa wey dey manej im moni fo am du Spanish govament jibiti plos wayo wey rish $4.6m.

If dem faind dem giliti fo court, na 22 yiez dem go spend insaid prizin.

Sins 2013, na im di mata dey court. Dat taim, Messi bin tok se im nor du eni bad tin at ol. Afta, Messi and im papa kom pe govament $6.75m fo tax wey im no bin pe bifo.

From 2007 to 2009 na im dem tok se Messi and im papa doj som moni wey dem sopoz pe fo tax.

Messi 26 dey kolekt $20m salari from FC Barcelona evri yie. Dat wan no inklud endosment moni wey Adidas, PepsiCo and oda sponso dem dey pe am.

As Forbes bin tok, ol di moni wey Messi mek last yie na $73.8.

"Wi dey olwes pe awa tax akodin to hau awa tax konsoltant dem arenj am. Na dem go still setul dis mata." Na wetin Messi tok fo Facebook bi dat.

Dis piksho wey sho Messi wit im palle insaid court na from by Alberto Estevez - Pool/Getty Images

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories