Di wuman we de fo piksho na Bara’atu Rabiu and na 22 yiez bi ha ej.
Won majistret court fo Minna don rimand Bara'atu fo prizin bikos shi kari naif kot ha ko-waif pikin somtin.
Dem say i don rich 7 yiez we Mr Rabiu mari Bara'atu bot shi no born pikin at ol. Bikos of dat, Rabiu go mari sekond waif.
Smol taim nau, di sekond waif kom born bebi boi o. Dis tin mek Bara'atu jelos sotey shi kari di bebi go bakyad. Na dia shi sidon kot di boi penis o.
Di kain laud krai we dis pikin krai na im mek pipul rosh to Rabiu haus to si wetin hapun. Bifo Bara'atu go ron awe, dem don grab am go hand over to polis.
Dis smol boi we dem nem Buhari afta Prezident Buhari de fo hospital nau de risiv tritment.
Bot dokto dem we de trit Buhari tok se wen im gro op, im no go fit bi man o. Dem say di rizin na bikos Bara'atu don damej di penis sotey na onli pis im go de yuz am pis.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.