Thursday, June 16, 2016

Germany koch tok wai im chuk hand insaid pant smel fo noz

Di oda de we dem de ple Ukraine fo Euro 2016, na im dem kach Germany koch, Joachim Leow fo kamera as im chuk hand insaid pant kom smel am fo noz.

Leow tok se na adrenaline kos di wahala o.

“Wen adrenalin ful yo bodi, tins de hapun we yu no nou.

“A don si di piksho dem and a go trai mek dat kain tin no hapun agen. A de sori fo wetin hapun."

As tins de, ivun German pleya we bi Lukas Podolski de bak im maneja.

Hie wetin Podolski tok.
“Notin de dia. Mi a nou se 80% of una de skrach una blokos somtaim.”

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories