Tuesday, June 28, 2016

EFCC arenj 2 wumen we tif dead pesin shares fo court

On Monday, na im Economic and Financial Crimes Commission, EFCCon  arenj tu wumen, Nneka Okechukwu and Nkiru Celine Okoro, fo Lagos High Court fo Igbosere.

Dem tok se dis tu akiuz pipul bin tif and sel won ded man shares we worth N119, 798,253.61 kom chop di moni. Na bifo Justice Oluwatoyin Taiwo dem arenj dem.

Okechukwu na bifo bifo Head of Business Development fo Heritage Capital Markets Limited, Lagos and Okoro bin de wok fo C. N. Ukachukwu and Sons Limited.

Dem de trai dis tu akiuz pipul on top of 19-count chaj we get to du wit join-bodi to du bad, wuruwuru, tifin and fojri. Ol dis ofens dem de kontrari to sekshon 9(b), 278 (1), 285 (1), 363(3)(b) and 409 of di Criminal Law of Lagos State, 2011.

Di prosekuto, Elizabeth Oyedotun tel di court se na fo difrent difrent det fo 2013 dis tu pipul join bodi komit di ofens.

Oyedotun tok se dem join bodi go sel shares we worth N119, 798,253.6 “propati of di Estet of  Cyril Ukachukwu we don dai, we bi se dem put fo dia hand mek dem kari put fo di kompeni we bi  C. N. Ukachukwu and Sons Limited, kom rikova ol di dividend dem we di shares sopoz to get."

Bot insted of dem to du as dem send dem, dis pipul jos go sel di shares chop di moni.

Hie wetin Oyedotun tok.
“Somtaim fo 2013, di difendat dem kari lai lai konvat to dia oun yuz, N63,028,785.32 and N20,000,000, we bi moni fo shares we dem sel, and na propati of Ukachukwu.

“In July 30, 2013, di difendat dem konvat N33, 736,846 to dia oun yuz, we bi se na di moni of shares we Ukachukwu bin get fo  Nigerian Breweries. "

Oda shares we dem sel chop moni na from First Bank (N277, 000), UACN (140,789.59), United Bank for Africa (UBA) (N1, 453,657.75), Union Bank (N81, 186.04) and African Prudential Bank (N1, 079,988.91).

Dem say Okechukwu ivun “foj di Heritage Capital Markets Limited letter on December 16, 2013 we shi kapshon “RENEGOTIATED OUTSTANDING” kom adres to di Executor/Justice P. C. Onumajulu (Rtd).”

Dem say Okoro bin foj meni dokument fo Lagos fo difrent difrent det fo 2013 kom lai se na wetin Board of Directors of C. N. Ukachukwu and Sons Limited bin disaid.

Afta dem hie ol di chaj we di prosekuto put fo dia hed, di akiuz pipul tel di court se dem no komit eni ofens.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories