Wednesday, June 8, 2016

Bad day fo Naija futbol: Keshi don waka!

Hevi badness don hapun fo Naija futbol o.

Naija futbol fans dem wek op dis monin kom hie se bifo bifo Super Eagles kaptin and kochii wey bi Stephen Keshi don kari waka o.

Dem se Keshi bin dai eli mor mor fo Wednesday June 8, 2016 fo Benin citi, Edo State.

Famili pipul tok se Keshi no bin sik at ol at ol o. Im jos enta bed kari waka jos laik dat.

Dem kom de tok se Keshi nor fit foget im waif of 33 yiez wen i neva tey wey shi dai and im no kom fit manej laif witaut di wuman o.

Hie wetin wan famili memba tok. "Im nor sik at ol o, and im nor ivun sho eni sai i get as bodi de du am. Bot i bi laik say dat im waif wey cancer kil, di tin pen am sotay im sef kom dai folo am.

Keshi na wan of di onli 2 pipul wey don win Africa Cup of Nations as pleya and kochii.

Na 54 yiez di Big Boss bin dey bifo im kari waka.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories