Saturday, November 4, 2017

Konfam Tori: Ifeanyi Ubah don komot fo PDP

Oga on top fo Capital Oil & Gas Ltd we bi Dr. Ifeanyi Ubah don konfam se im don komot fo Peoples Democratic Party, PDP o.

Ubah we bi se im de bak Govano Obiano fo di elekshon we dem wan du fo Anambra Stet bin tel niuz tori pipul on Saturday se "mi a bi strong Igbo man and a wan tok am hoha say a ful grand to mek shuo se Anambra and Igbo oun no go los."

"Afa Igbo ama efu!", na so im tok.

Uba kom tok say wetin mek am komot fo PDP bi se dem shuk am "knife" fo bak fo dat pati.

I kom tok agen say i swit im bele wela to riton to All Progressives Grand Alliance, APGA wia im stat im waka fo politiks.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories