Friday, July 28, 2017

Di Mata of Yam and Goat: Naija languej puem

DI MATA OF YAM AND GOAT
Di tin we konsan yam and goat,
No bi smol mata at ol,
Bikos eniwia goat si yam,
I de laik to chop am.
So if yu si goat
De ple ple nia yo yam,
I beta mek yu poshu am,
Bifo im go trai nonsens dia.
If yu si goat de smel smel yo yam,
No wet to si weda im go chop di yam o.
Yam na fud we goat de laik,
And na smol tin
Pesin tin de tek turn
To anoda pesin oun.
Pesin we sabi pand yam
De pand insaid mota,
Bot hu no sabi pand
De pand im oun fo grand.

© Steve Igbokwe 2016

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories