Thursday, May 18, 2017

Hau dem kpai bifo bifo PDP chiaman fo Bayelsa

Bad bele pipul don go kpai bifo bifo Acting Stet Chiaman of Peoples Democratic Party,PDP fo Bayelsa Stet, Mr . Christopher Hobobo.

Dem say Hobobo bin de rilax insaid palo fo im haus we de fo PDP Road, Yenagoa , di stet kapital wen dis pipul spoil im get kom mit am.

Na so dem kari naif chuk chuk am fo bodi til im kom kpai.  Dem say dis bad pipul no shut gun at ol o so dat im nebo dem no go nou wetin de hapun.

Divisional Police Officer, DPO Ekeki Division, na im kari im men kom komot di dedbodi go put am fo Federal Medical Centre, Yenagoa, afta de don brek finish.

Dis badnes bin hapun onli 1 mont afta som bad bele pipul go kpai 1 niuz tori pesin we dem de kol Mr. Famous Giobaro fo di sem Yenagoa.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories