Dem go hang Moshood Owolabi fo nek ontil dem konfam se im don dai kpatakpata.
Dis na wetin Justice Adegboye Gbolagunte of Ibadan High Court tok on Tuesday as im de giv jojment fo di ofens we di yong man bin komit.
Owolabi na 200 levul student of Physical and Health Education fo South Western University.
Di prosekuto Mr. A. Olawale, we bi Deputy Director fo Oyo Stet Ministry of Justice, bin tel di court se somtaim 3 yiez ego on
January 12, 2014 fo toll-gate eria of Ibadan, Owolabi bin stab anoda student we bi Kolawole wit broken botul fo nek.
Bikos of di injuri, na im kolawole kom kpai. Im kom tok say di
ponishment fo di ofens de fo Section 319 of di Criminal Code Cap. 38 Vol. II Law of Oyo Stet, 2000.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.