Di Govano of Ekiti Stet, Ayodele Fayose de wori se All Progressives Congress, APC de plan to tek bai faya bai fos komot am fo ofis bifo im taim go finish fo October 2016 .
Insaid di komplen we im rait to Acting Chief Justice of Nigeria we bi Justice Walter Onnoghen, Fayose tok se APC wn folo bakyad yuz court komot am fo ofis.
Fayose tok se wetin mek dem wn komot am fo ofis bi se im no gri join APC and on top of dat, im de yab Buhari evritaim.
Di govano kom swia se im go kontiniu to de yab di Buhari govament.
"A no go klos mai maut. Nobodi fit klos mai maut fo mi." Na so Fayose tok.
Fayose tel niuz pipul fo Lagos se som big big pipul fo APC de waka ondagrand to braib som judge dem so dat dem go komot am fo ofis.
Im say dis na afta dem don trai to komot wit balot box, elekshon petishon traibunal, plos Appeal court and Supreme court bot di tin no work.
Fayose say di pipul we de giv am ol dis wahala na Oni and Kayode Fayemi.
"Dis 2 pipul don swia se notin we dem no go du to komot di pawa we Ekiti pipul giv mi fo mai hand. Dem de faind koropt judge we dem go bai jankara jojment fo im hand so dat dem go yuz am komot mi fo ofis.
"A get hop se God go fait fo mi as im de olwes du."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.