As jongul don mature fo Naija fo dis Buhari govament of chenj, plenti car ouna de tok se i mek plenti sens to kip dia moto fo haus, kom de yuz danfo fo dia de to de rons.
Akodin to di tochlaitin we News Agency of Nigeria, NAN bin du fo Abuja, pipul de tok se as grand no kom levul agen, dem nid to manej di smol smol moni we de enta poket.
Dem say sins petrol komot fo 87 naira kom enta 145 naira, to bai fuel kom menten moto on top no izi agen o.
Fo govament woka, Romanus Duniya we de liv fo Lugbe, Abuja, "to fuel and menten mai moto, kom stil mit op as famili man de tu difikolt nawadez.
" Sins fuel put moni, evritin fo maket don go op, bot sivul savant salari neva inkriz.
"Na wi govament woka de sofa am pas bikos biznes pipul fit top moni fo dia maket. Di onli opshon we a get nau na to trowe di moto fo won said mek a de folo danfo. "
Fo Kabiru Isa we bi biznes pesin, to fuel praivet car no mek sens agen.
Isa tok se to sovaiv fo biznes no izi agen as maket no de, opon se tins jos de put moni eni hau.
" Sofa sofa tu moch fo Naija nawadez. Wi de pre mek God giv dis govament sens so dat dem go komot os fo dis wahala we de fes fo awa kontri."
NAN tok say pipul de beg govament to bring daun di praiz of petrol bikos i de toch evritin fo maket.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.