Friday, November 25, 2016

No jok wit pre-paid meter o - EEDC

Enugu Electricity Distribution Company, EEDC don tel dia kostoma dem say mek dem no trai put eni monkey hand fo dia pre-paid meter.

Madam Patience Ezeagu, we bi EEDC Communication Manija tel niuz pipul fo Enugu on Friday say di kompeni de los beta moni bikos som pipul de du som kain wuru-wuru konekshon we bi se di pawa we dem yuz no de sho fo meter.

Ezeagu tok se di kompeni go sun stat to de waka from haus to haus to kach di pipul we de du dis monkey biznes fo dia meter.

Shi kom rimaind konsuma dem say di penariti fo dis ofens na 50k.

“Penariti of N50, 000 de wait fo enibodi we tampa wit awa pre-paid and post-paid meter.

“I beta mek yu re-charge insted of to by-pas. If yu du enihau, yu go si enihau." Na wetin shi tok bi dat.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories