Chelsea midfilda, John Obi Mikel don tok say im fit folo di January transfa windo komot fo English Premier League o.
Di 29 yiez old Naija pleya don de Chelsea fo 10 yiez nau. Afta John Terry, no oda pleya do tay fo di klob laik Mikel, bot dis sizin, im no si bol ple o.
"A go stil de trai mai best enitaim dem selekt mi. Bot mek wi si wetin go hapun fo January."
Super Eagles koch Gernot Rohr tok se dem de ponish Mikel bikos im liv klob go ple fo kontri fo Rio Olympics, bot Mikel say dat bronze we im win fo Brazil pas enitin we im don win fo Chelsea.
Sins 2006 we Chelsea bai am fo £16m from Lyn Oslo of Norway, Mikel don win 2 Premier League taitul, 4 FA Cup, 1 Champions League and 1 Europa League taitul.
“A no bi di kain pesin we de eva komplen abaut enitin fo mai laif. Di tin bi se a de olwez du mai wok.
“A go stil de train hard to mek shuo se a shenj manija Conte maind. Na profeshonal a bi, and a de train and wok everide wit di tim and a get hope se won day a go ple.
“A don rait mai nem fo di histri of dis futbol klob and a don win plenti trofi hia . A don ple olmost 400 mach fo Chelsea and a no get eni rigret.
“A stil wn help di klob win mou tins, bot wetin de dia bi se pleyas de shenj klob somtaim. So, a no de wori maisef abaut January." Na wetin Mikel tel BBC World Service Sports bi dat.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.