Thursday, September 8, 2016

Si hau Ebola chenj ha laif

"A de sik. A de hongri. A no si fud chop. Laif don taya mi. A no nou se laif go kom de laik dis fo mi."

Na 16 yiez old Alice Koudouno bi dis. Alice na skul girl bifo we bin get ambishon to bikom journalist.

Alice bin de poshu ha ambishon witaut eni wahala ontil 2014 wen Ebola  kari trobul waka enta ha smol vilej fo Guinea.

Alice papa na dokto and im bin get Ebola from peshent we kom im hospital. Bai di taim Ebola finish wit di Koudouno famili, 15 pipul don dai inkludin papa and mama.

Ivun Alice folo kari Ebola bot shi manej to sovaiv.

As Alice Koudouno tel Elizabeth Payne of OTTAWA CITIZEN, ivun dou Ebola don go,  shi stil de sofa. Ivun wit ha Ebola certificate of sovaival, shi stil de sofa rijekshon and povati.

Laik oda pipul we sovaiv Ebola, nobodi wn nia Alice ou ivun giv am fud ou moni. Ivun wok sef, nobodi wn giv dem.

“Wen a ask pipul fo moni, dem go say: ‘Wi no go giv yu awa moni; yu bin get Ebola; komot fo awa haus, komot."

If yu si hau Alice de krai as shi de tok abaut ha kondishon, yu go nou se laif don taya am.

Ivun afta extended famili memba dem poshu am fo ha papa haus afta di man dai, nebors no gri help am bikos of Ebola.

Shi jos de manej ha laif with ha frend fo won smol kona.

“A de manej wit won veri poor famili. Na big wahala a de so.”

Tugeda wit ha frend, shi de kari vejitebul go di vilej maket bot nobodi de gri bai from dem bikos pipul de fia Ebola.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories