Sunday, August 28, 2016

Polis de faind wetin kil man, 37 fo wuman haus

Lagos Stet Polis komand don kari dia tochlait de sach evriwia to nou hau manej 37 yiez old Sikiru Olanrewaju kom dai insaid  wuman haus fo Abule-Egba eria of Lagos.

Dem say Sikiru bin go im girlfrend haus fo Surulere strit last wik Tuesday to spend di nait and kach fun, bot wahala kom stat in di morin wen im no fit wek op agen o. 

Fo nau, nobodi nou wetin kil Sikiru bikos dem no si eni injuri fo im bodi.

Di tok-tok pesin fo Lagos Stet Polis komand, Dolapo Badmos tok say polis from Oke-Odo divishon don go shek di ples and olso snap piksho dia. Shi say dem no si eni injuri to sojest se na pesin kil Sikiru, bot dem don kari di dedbodi go put fo moshuari.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories