IDi hol wold don hie se won big oga fo First City Monument Bank, FCMB bin shut imsef fo hed in front of im pasto on Friday, July 2016.
Bot wetin pipul wn nou nau na wetin push dis man we get beta job to kil imsef.
Pipul bin de tok se na bikos of 350 milion naira loan we hang fo im nek im kil imsef, bot nau im employa we bi FCMB de tok say dem no nou wia dat moni stori from kom.
FCMB tok say i bi laik se na bikos of som kain pesonal shalenj we Olisa Nwakoby bin get im kil imsef, bot as tins de, dem don de put hed togeda to diskova wetin mek di man tek dat kain akshon.
Egbo tok say if di Bank nou se Nwakoby get problem, dem fo help am to faind di solushon.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.