Baba Buhari don tok se ol di pipul we tif Naija pipul go fes di law, and afta court don konvikt dem, dem go riton di tins we dem tif.
Buhari say no amaunt of presho go mek am to stop to de poshu koropt pipul.
Mista Prezident tok dis won during di taim we som pipul we de sopot anti koropshon fait go grit am fo Prezidenshal Vila, Abuja.
Im tel dem say enibodi we dem si oyel fo im finga se im don shuk hand insaid sup, dem go kari am go court. Afta court don konfam se tru tru, dem komit di ofens, govament go tek bak ol di moni we dem don tif bifo plos ol di propati we dem bai insaid.
"A biliv se di taim don kom fo Naija to chenj dairekshon. Na wetin mek mi beg Naija pipul to mek mi dia prezident bi dat. A wn help awa kontri to rimuv dis epidemik we dem de kol koropshon."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.