Friday, August 5, 2016

Na onli 4 moto a don tif dis yie

Polis fo Lagos don arest won Muslim pasto, Rasheed Ayuba we don de stil pipul moto sins.

Dem kach Ayuba wit won transpota fo Ibadan, Oyo Stet Falade Igbekele we don bai 6 of di tif-tif moto from im hand.

Dem say di tin we dem rikova fo Ayuba hand na bonch of master key and 13 oda car key dem, plos difrent taip of charm.

Naija Languej hie se Ayuba we bi tisha fo won Islamic skul fo Isashi, Lagos bin enta won hotel fo Lagos in June, go kari won Toyota Camry we dem pak dia.

As im de waka wit di moto, na im vigilante pipul kach am kom hand am ova to Special Anti Robbery Squad, SARS.

Ayuba tok say im bin bai di masta key N9000 from won John from Benin Ripoblik.

"A bin bai di masta key in 2013 fo Lagos. Sins dat taim, a don de yuz am tif moto.

"A get kostoma fo Ibadan we de bai di moto. Won of dem na Falade Igbekele we don bai 6 moto , and Friday we bai won Toyota Camry.

“Na onli 4 moto a don tif dis yie bifo dem kach mi. A bin sel Toyota Camry to won Pastor Dare fo N100,000, and  Honda fo N80,000 to anoda pasto. Bot na onli N50,000 Pasto Dare don pe mi.  Ol of dem nou se a  tif di moto.”

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories