Won old man we de kom bak from farm don dai afta di bus we de fo di convoy of Delta Stet Govano Ifeanyi Okowa jam am.
Dem say di farmer de waka im oun jeje fo rodsaid wen di bus we bin kari niuz pipul we folo Okowa go okeshon fo Warri kom liv rod go jam am.
Akodin to aiwitnes dem, som of di tori pipul insaid di moto bin get smol smol injuri from di aksident.
Dem don put di dedbodi insaid moshuari fo Asaba, bot won polis man we konfam di tori no gri tok im nem bikos di tin get as i bi se govano moto kil sombodi.
Naija Languej hie se di draiva of di moto de fo polis hedkwota fo Asaba de esplen hau im manej kari im moto go kil pesin we de waka im oun jeje fo kona.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.