YEYE DE SMEL
A sabi smel of pafum
A sabi smel of beta fud
And wen gota bigin smel
Na wans a go stil tek nou
Maskured ton Kwaya masta fo shosh
Evribodi de klap de dans
Wen Im bigin giv komunion wit agidi and Pam oyel
Evribodi bigin kari fes
Politishan bai wan kon fo yo hand
Giv yu tu tausand naira
Im de pe yu yo penshon
Yu no si pesin tel yu
Dem kom, giv yu "salt" giv yu "rice"
Yu kari bodi, go pres finga fo dem
Yu de chop yo fiusho
Yu no si pesin tel yu
Dem bring yu tori se beta de kom
Dem promis se dem go kari hevun kom daun
Yu folo fo "sun" de jomp op an daun
Bot dia shidren de oyibo land de enjoi
Nau akara don skata fo oyel
Yu kom de komplen
Yeye bin de smel dat taim
Bot yu no sospet
©Albert Seraphim
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.