Wahala de fo Psquare as Peter Okoye de veks se im twin broda Paul no tel am bifo im go buk sho fo Congo fo dia nem.
Onto dat levul, Peter enta Instagram wia im ishu disklema se im no get eni to du wit di sho we Paul and dia sinio broda Jude de promot.
“MAI HAND NO DE: Dis na fo ol mai fans insaid Congo and di entaya wold. A hie se som bad bele pipul don de advataiz won sho we go hapun tode, 8th July, 2016 (VIP SHO) and tumoro, 9th July 2016 in Goma and on August 17 fo Kinshasa, we bi se dem kari di nem Psquare to disiv pipul to komot. Na Rudeboy bi di nem we dem sopoz to yuz as mai broda we mi and am folo get Psquare de pafom elon.
"No taim we a pamit mek dem yuz mai nem, bikos di kontrakt we dem kari kom mit mi no swit mai bele. So, mi a no folo fo di sho we awa bifo bifo maneja Jude go arenj and a komot mai hand kpatakpata fo dia wuru wuru yuz of di nem and imej of Psquare we a folo get to de hozul fo moni witaut mai pamishon. Dem tel pipul se na bikos a no wel mi and mai pipul mis awa flait fo di sho, bot a de tok am nau se notin du mi. A wn tok am ho ha se a de 101% kampe.
"I no go tey bifo a go kari ol dis bad bele pipul we de spoil mai nem go court. A tank una.
MR.P (Peter of Psquare)”
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.