Friday, July 29, 2016

Ras Kimono say yong Naija atist dem de ple mumu and yeye muzik

Yong Naija muzishans de provok long taim reggae masta, Ras Kimono. Di dub masta say im de veks fo di kain muzik we dem de ple fo Naija nawadez.

Di "Under Pressure" singa de hala se nobodi de sing "reality" song agen. Im say plenti tins de hapun fo Naija bot nobodi de kari am sing.

Kimono bin yan wit Showtime di oda de, and im tel dem say:
“Non of di niu atist de sing beta reggae nawadez. Dem de fia to sing rialiti. Na onli wuman yansh and yeye tins dem de sing abaut. Dem jos de sing mumu and nonsens song.

"Si wetin de hapun fo Naija tode. Mista Prezident na im stil bi Petroleum Minista and nobodi de sing abaut am. A de veks."

As dem ask Ras Kimono kwich Naija atist im go laik to wok wit, im kom hala say; "kwich won of dem a go laik to wok wit ou kwich won of dem go laik to wok wit mi? Dem no de ivun ple beta reggae, so a no nou hu a go laik to wok wit among dem."

Kimono tel Showtime say no bi tru se reggae don dai fo Naija.

"As long as Ras Kimono de alaif, reggae stil de alaif fo Naija. If reggae don dai, mi and yu no go de hia de tok.

"A de fo studio de wok. Bifo dis yie go finish, a go kom aut wit beta muzik we pipul go laik."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories