Oodua Peoples Congress, OPC don tok say dem get di abiliti to difend ol di stet dem fo South West Naija.
Onto dat levul, di Yoruba oganaizeshon don "warn" Niger Delta Avengers, NDA and oda militant grup dem mek dem no kari dia trobul enta Yoruba land, odawaiz dem go si OPC red aiz.
Insaid won stetment we dem taitul “Incursion of Ijaw militants into Yoruba land: Enough is enough” we bi se na Comrade Dare Adesope sain am, OPC tok se: “I don du fo ol dis Ijaw pipul we de enta awa land eni hau to kil and kidnap.
"Wi Oodua Peoples Congress don de wet fo long taim to si weda govament go kontrol di bad bad tins we Ijaw pipul de kom du fo awa papa land fo Ogun and Lagos Stet. Bot wi don si se awa laif and propati dem no mata at ol to govament and dis Ijaw militant pipul.
“Evribodi nou se wi Yoruba pipul no de faind trobul. Wi de akomodet evri traib fo Naija to ste fo awa ples ou to du dia biznes. Bot if dem wn sho os se wi bi mumu, wi sef go sho dem se di jentul we tiger jentul no min se im de fia.
"Bifo nau, na Fulani herdsmen. Nau na Ijaw pipul de giv os wahala. I don du fo dem.
“Nau wi de giv Ijaw militant dem 14 dez to stop ol dia trobul fo awa land. If dem no stop, from nau, i go bi "an eye for an eye and a tooth for a tooth." Wi go sho dem se na Yoruba get Lagos, no bi no man's land as dem de tok sins.
“In kes dem don foget, wi nou wia dia pipul get propati fo South West and wi nou wia dia pipul de liv fo South West.”
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.