Long taim Nollywood aktres, Patience Ozokwor, aka Mama G tok se shi no de wia trauza agen.
Shi tel Encomium say no bi enibodi kom tel am enitin, bot Jesus bai Imsef apia to am wit di mesej.
“Jesus tel mi to drop som kain tins bikos im no laik dem. A get to obe Am . A bin hie dairek from Jesus, no bi se na pesin tel mi.
“Jesus Christ tel mi se to wia trauza de komot wuman bodi, sotey men go de get som kain aidia fo dia maind we go mek dem komit sin. A bin agiu di tin wel wel bifo a kom de obe di instrokshon."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.