Indigenous People of Biafra, IPOB don de hala bikos of hau Naija sekuriti ejensi dem de olwes haras pipul fo Biafra we dem tink se dem bi IPOB membas.
Onto dat levul, Emma Powerful we bi Media and Publicity Officer fo IPOB don riliz stetment wia im komplen se Department of State Services, DSS de haras and intimidet inosent Biafra pipul.
“Sins May 29 and 30, 2016 we DSS and oda sekuriti ejensi dem kom kil awa pipul fo notin insaid choch fo Nkpor, Anambra Stet, dem stil de waka abaut de arest enibodi we dem sospekt se na IPOB memba to go trowe dem insaid prizin witaut trayal.
“IPOB de veks as dis pipul jos de waka insaid Biafra land de arest pipul enihau. Plenti of awa pipul de mis we wi no ivun nou wia dem de.
"Wi de beg di intaneshonal kominiti to help os. Wi no fit de sofa laik dis jos bikos wi wn get awa oun kontri."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.