Thursday, July 28, 2016

Drog ofens: Indonesia don kil 3 Naija pipul

Smol taim afta midnait on Friday morin na im Indonesia shut and kil won lokal pesin and 3 Naija pipul we dia court bin konvikt fo drog ofens.

Noor Rachmad we bi "Deputy Attorney General for General Crimes," na im tel niuz pipul wetin hapun, bot im no tok wai dem liv di oda 10 pipul we dem bin plan to kil di sem taim.

Hie wetin im tok.

"Fo nau, wi jos kil 4 konvikt dem we don de fo "death row.

"No bi se wi de enjoi dis kain wok. Wi awa sef de fil bad bikos na pipul laif wi finish so.

"Wi no du am to tek laif. Wi du am to stop dis ivul we bi drog trafikin."

Di 4 pipul we dem egzekut so bai fayarin skwod na Freddy Budiman we bi Indonesian, and 3 Naija pipul we bi Seck Osmane, Humphrey Jefferson Ejike Eleweke and Michael Titus Igweh.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories